Lagbaja - Dress With Sense

Okay, na who you think start fashion put earring for ear?
Who you think first wear am for nose? So fun mi.
Na we begin the fashion make bead for neck
Even self wear am for waist
Na who you think first dey do suku?
Abi because oyinbo dey call am braid, corn row?
Na where you think them copy dreadlock?
You no know na from Dada?
Na who you think first dey paint them face?
Wey oyinbo come dey call make up o
Na where you think them copy tattoo?
Na our body mark now
African color sense, se na kente make I talk abi ofi?
Abi adire eleko, wey oyinbo come dey call batik, tie and die
African color sense, ko selegbe anywhere
Awa ti nsoge ki won to soge, awa ti nlogba ki won to logba
Asese soge bee lo nse ni
Ah ee tungbe, pa pa pa tungben…sha sha tungben..
So fine girl make up your mind
Appreciate o, appreciate your heritage
You want to dress? Abi you want to undress?
Better to dress with sense (Repeat)

O woso bi alai woso, o lo mi se fashion
You dey dress like say you undress, you say na fashion
Wetin remain for confidential, when everything done expo patapata?
No fashion anywhere pass our own
Ko si fashion kan, to ju tia lo
Iro ati buba yen pelu gele skontolo
Any woman tie wrapper, nak gele skonto
She go fine one time, she go fine well well
Abi you done see woman tie gele come wowo?
It ‘s not possible at all
Even oyinbo flat bottom, tie am fine one time
Iro ati buba yen pelu gele skontolo
Iro ati buba le pelu gele skontolo
Ah! So fine girl make up your mind
Appreciate o, appreciate your heritage
You want to dress? Abi you want undress?
Better to dress with sense

Comments

  • ×