Lagbaja - Different Cloth, Different Occassion

As for me mukomuko
I go talk true make devil kini?
I go talk true make devil shame
The dress fine
…En?
En! I like am o
…You like am?...Lagbaja!
Yes. I no’ be hypocrite and pretender like tani?
I no’ be hypocrite and pretender like you…Liar liar!
…Well it’s not too bad sha
But listen to me well well before you confuse
The real matter o not be the dress gan
Na the place you dey wear am, na him the wahala o
Different different cloth for different different occasion
You dey go for the church - It get wetin you go wear
You dey go mosalasi for mosque- It get wetin you go wear
You dey go for party
You dey go Lagbaja
You dey go for lecture
You dey go for work o
You dey travel for yonder for winter
You na de go for swimming pool
Applicant wey get interview se he no’ go dress smart?
You dey go your school
You dey go for sport o
You dey go for burial for cemetery
I say different different cloth, different different occasion
E ma gbomo Oba fOsun
You want sleep for night, if you like off your dress patapata
Aa na your room now
But for road, for town gbangba?
Haba! Aifeni peni, aifeniyan peniyan
Lo nmara oko san bante wolu
Pa pa dun gbe… sha sha sha dun gbe
Se you never hear the word before dignity?
Se you never hear the word before decency? (Repeat)
Even though na free society, remember dignity decency
Se anything oyinbo do, youself must copy like mumu?
That our culture wey you no appreciate
Na from there oyinbo dey find inspiration
See o, you the original come dey copy, the copy like ignoramus
You not know, you not know na we teach them father father fashion
En…you no go believe…how you go believe? Ignoramus like you

Comments

  • ×